INTRODUCTION

If you get access to phone, internet and post office, you fit get admission to any higher institution for US or Canada. Dis na true talk. I no wan begin yan plenty for dis website. So wetin I go do na to give you de koko wey you need to find skool for dis two countries.

I know say plenty people no know where to start when dem wan find admission abroad. And I also know say plenty of us wan go abroad go study. Well, we all know why. Dem no dey get strike and oda wahala wey we get for we skools. You know when you go gradge from de first day wey you start skool.

Anoda tin be say plenty people tink say to go skool for yankee dey very expensive. Dat one fit be true. But depending on wetin you know and de skool wey you attend for yankee, you fit no spend too much money and you go still get de same quality of education like de oda expensive skools. And dis one go depend on how much info wey you get about how to find cheap skools.

For dis website, I go tell you de tins you need to know for different pages and I go try to explain dem well well, so dat any person wey read de info for dis site no go find am hard to understand my yans.