HOW TO FIND SKOOL

Internet go be ya best friend when you decide to find de skool you wan attend. But first you must make sure say you know wetin you wan study. And with ya pen and paper, you go begin take note of de tins wey you go find out about each skool. To find skool na process wey you suppose take ya time do.

For each skool website, you go go for de programs/academics section to find out de fields wey dem dey offer. If you wan be graduate student, you must find out if dem get Masters or Phd program for de course wey you choose. Make sure say you write de head of dat department directly so dat him/she go know say you get interest for dem department.

De next tin na for you to find out dem entry requirements. Na here you go find out wetin dem wan you to send with ya application. Every requirement wey you see for de webpage dey very important.

But as you be international student, you must go the international student page to find out admission requirements. Most of de time international students get different requirements. Dem get different application deadline, application fee, tuition fee and plenty oda tins. So you must pay attention to de international student page of de skool you wan apply to.

Most skools get special scholarships for only international students. You get to ask (send email or call) de international students office. Dos guys go give you all de info wey you need to know about how to apply for scholarship as international student. Dem go also tell you how to join dem organization, when and how to apply for dem schorlaships.

As you dey find de skool wey you wan attend, make sure say you dey search for accommodation too. De registrar office fit direct you on how to find out about accommodation.

I go advice all freshman and transfer international students to spend at least dem first semester on-campus. Dat one go helep you settle down. Ee no go dey good for you to begin attend class from off-campus.

If you dey on-campus for at least ya first semester, you go get enough time to find off-campus accommodation wey dey safe and cheap for you. You need to dey de town and understand how de town dey operate before you go off-campus.

But off-campus be de best type of accommodation for international students. You fit live with person wey understand ya culture or way of life, cook de food wey you like to eat and you go get enough space and time to relax when you wan to. And ee usually dey cheaper.


**Make sure say you know de ‘means of payment’ for anytin wey you suppose pay for. Most times ee dey hard to pay for anytin from Naija to abroad. But you still fit do am. You fit send US dollar/Canadian dollar money order or bank draft. Just make sure you make am payable to de right person or place. You fit also ask any person you trust wey dey live for yankee or Canada to helep you pay de money for you online. And now some banks fit helep you do payments online. You get to go de banks and find out how to do dis one. No ever send cash oo!! If you do dat one na im be say ya money don loss be dat.