BEFORE YOU TRAVEL

Afta you don succeed with ya visa (I dey sure God go helep you get am), make sure say you buy ya ticket on time so dat you go arrive skool on time for you to register early. When you first arrive, every tin go dey you confuse. So ee go beta make you arrive some days before de main day wey registration go start. Dis one go give you enough time to go round everywhere wey you need to know for de skool. You need to know where you go take classes, where you need to go eat, all de office wey you need to visit like de registrar or international student affairs office.

Begin look for oda Naija or African students to make friends with. De country people for yankee and Canada no too dey open to foreigners oo!! Ee go dey lonely de initial time wey you enter de country. So begin find Naija or African people. Dem go helep you adjust fast fast for ya new environment. Onyibo people dey private. So you no go dey approach dem de same way you dey take approach person for Naija. You need to dey careful with de way you begin make friends.

If you be freshman, ee go beta say you no work at least for de first semester. Dis na because you go need enough time to do ya skool work. For abroad, nothing like abeg when you begin get bad grades. Ones your GPA (Grade Point Average) dey below, dem go put you for probation. And if ee still dey below afta second semester, na im be say you go just pack ya bag begin go back to ya country. No abeg for dem side.

And if you wan maintain ya scholarship wey dem go give you, na im be say you must reach some kind GPA wey dem set for you. When you don settle well and you believe say you fit handle ya skool work, den you fit go begin find work to make extra money. To go skool for yankee or Canada no dey dat easy! You need to work hard to make am.