FACTS ABOUT SKOOLS FOR USA and CANADA

For USA and Canada, you fit gain admission to start skool for three main semesters:
  • Fall Semester:
Dis na de main semester wey most students dey apply for admission. And na semester wey most skools dey accept application from students wey dey oversea (international students). Admission for most skools be around August. But some dey admit for September. Na for dis semester skools dey give out most scholarships and financial aid.

  • Spring Semester:
Na de second semester for skools abroad. Admission no too dey plenty for dis semester. Skools dey give out few scholarships for spring. And oda benefits wey you fit qualify for as international student go don finish for fall semester. Dat one no mean say you no fit apply for spring semester. You fit still get admission as international student for dis semester. Spring admission for most skools be around January.


  • Summer Semester:
Na de last semester for every skool year. Na very short semester. Admission dey very scarce for summer semester. Na mainly for students wey dey look for how dem go take make up dem skool work and to gradge quick quick. If you dey look for summer admission, you must first find out from de department directly if dem get space for you to apply to dem program.

Higher institution for US and Canada dey two main types. Dem be:

  • College:
Na skool wey students fit attend for just two years. Na mainly where you fit just go for half of de time you need to complete any program. De main degree for college na Associate Degree. Some colleges for Canada dey call dem college “Institute”.

  • University:
Na skool wey get at least four year degree program. Na here you fit study for Bachelors. Masters and Phd.

**If you wan study any professional program like medicine, law, engineering for US or Canada, you must first go get bachelors for different field. Like say you wan read medicine, you must first go read something like biochemistry or biology e.t.c. graduate for dat one, den come apply to read medicine. Wetin dis one mean be say dem no get direct admission to do any professional program. So if dis na ya plan, you now know wetin you suppose do.

**De way US and Canada skools dey calculate dem GPA dey different from Naija skools method. Dem maximum GPA (Grade Point Average) na 4.0 points while awa own na 5.0 points. So for you to know wetin ya GPA go be for US or Canada, go online to www.foreigncredits.com. For de section wey be for students, click ‘free GPA calculator’. Type in all ya grades and de site go convert am for you. But I go advice you to minus 0.1 from any GPA wey de site give you. Dis one go make you dey on a safe side.