FOLLOW UP


I go summarize de steps you need to take when you wan gain admission for yankee or Canada:

Freshman/Transfer Students
  • Search for skools, find at least four skools wey meet ya needs. Make sure say you know wetin dem want, like: GPA, application fee, application deadline, tuition fee, admission requirements e.t.c. Den as you begin de application process, you go come decide de skool wey be ya best choice.
  • Register for ya exams. You fit register for exam by ya sef or you fit register through de representative(s) wey de exam body approve for de country wey you dey live.
  • Prepare for de exams. I no fit over explain dis one. De score wey you get for ya exam be de most important tin each skool dey look for before dem give you admission and scholarship.
  • Start to arrange for ya transcript:
    • Freshman student: Go meet ya principal and ask am for ya transcript. Ee dey take some time to get am, so make you start on time.
    • Transfer student: Go de registrar office for ya skool and ask dem for ya transcript. Ee dey take some time to get am, so make you start on time.
  • Make sure you send all de documents you need to send on time. No late submission.
  • Contact de skool/department to find out if dem don get all ya documents. You must call dem for phone and send dem email from time to time so dat you go know de progress you dey make for ya application process.
  • If you get admission, start to prepare for ya visa interview on time. Make you read de VISA section for dis book to understand wetin you suppose do.

Graduate Students
  • Search for skools, find at least four skools wey meet ya needs. Make sure say you know wetin dem want, like: GPA, application fee, application deadline, tuition fee, admission requirements e.t.c. Den as you begin de admission process, you go come decide de skool wey be ya best choice.
  • Register for ya exams. You fit register for exam by ya sef or you register through de representative(s) wey de exam body approve for de country wey you dey live.
  • Prepare for de exams. I no fit over explain dis one. De score wey you get for ya exam be de most important tin each skool dey look for before dem give you admission and scholarship.
  • Go de registrar office for ya skool to ask for ya transcript. Ee dey take some time to get am, so make you start on time. And make you go get reference letters from de lecturers wey know you well well. You go need dem to write solid reference letter for you.
  • Make sure you send all de documents you need to send on time. No late submission.
  • Contact de skool/department to find out if dem don get all ya documents. You must call dem for phone and send dem email from time to time so dat you go know de progress you dey make for ya application process.
  • Try to contact de professors for de department wey you dey apply to. Most skools no go give you admission unless you fit find professor wey go gree to supervise ya graduate work. So start on time to find one.
  • If you get admission, start to prepare for ya visa interview on time. Make you read de VISA section for dis book to understand wetin you suppose do.