HOW TO SAVE MONEY

Dem get plenty cheap skools for US and Canada wey dey find international students like wata. So wetin you need to do na to spend quality time for internet, find skool wey reach ya pocket. De best way to save money when you be freshman student, na to do at least ya first year for college (dis na 2 year skool, so if you dey find skool make you search for COLLEGES). Dem fees usually dey very low.

When you finish de first year for college, you fit transfer to university to finish ya program. Or you fit finish de two years, den come transfer to university for de next two years wey remain for you to get ya bachelors degree.

If you be graduate student, ee go helep you well well to find professor wey go give you work for him office or him lab. Dis na de way almost all grad students dey take survive for abroad. So as you dey apply for admission, make you begin introduce ya sef to de professors for dat department wey you dey apply to. Dem go wan see how much you know about wetin dem specialize. So make you you go check dem webpage to see if ya interest be de same as wetin dem dey research.

As graduate student, you must to send solid cover letter to de professors dem wey you wan work under. If you no sabi write cover letter, go online go see samples and learn how to write am. You must know how to convince de profs dem because no be only you wey wan work with dem. So na ya yans for de cover letter wey go give you upper hand.

Apply for all de scholarships wey dey available to you. If you no ask, some skools no go tell you. Spend enough time for de website of de skools wey you wan attend.